Bobby Brown child death: Son of America singer Bobby Jr. don die - Dis na wetin you need to know

Publish date: 2024-06-06

19 November 2020

Bobby Brown Junior(Jr.), dat na di son of American singer Bobby Brown don die for di age of 28 years old.

Di elder brother wey be singer/songwriter, Landon Brown, confam di death of Bobby Brown Jr. through one Instagram post wey e caption, "I love you forever King." And pipo don begin dey console am.

Bobby Brown Jr. girlfriend, Anna Reed, tweet: "Di heavens gain an angel but I lost my soulmate".

According to report from tori pipo TMZ, dem find Bobby Brown Jr. dead on Wednesday inside im Los Angeles-area home.

TMZ quote one source wey dey close to di family say, police no believe foul play dey involve for di death of Bobby Brown Jr.

Bobby Brown Jr. wey be di namesake of im papa dey among one of di seven (7) children, wey include Bobbi Kristina, wey die for di age of 22 for 2015, LaPrincia wey be 30 years, Landon wey be 34 years, Cassius wey be 11 years, Bodhi wey be 5 years and Hendrix wey be 4 years.

Dis make am di second pikin wey Booby Brown don lost, just five years afta di death of im daughter Bobbi Kristina Brown, wey e born with im late ex-wife Whitney Houston.

Bobby Brown Jr. leave behind both im parents and five brothers and sisters; e neva born any pikin before e die.

How e take happun

Officers with di Los Angeles Police Department respond to one call for medical emergency on Wednesday around 1:50 p.m on di 5200 block of White Oak Avenue inside Encino, spokesman for di police division, Jeff Lee tok.

"Upon officers arrival, dem see say one pesin dey down for di location," Lee mention.

Dem pronounce Bobby Brown Jr. with no pulse for di scene, and investigators no consider foul play dey involve, police tok.

Wetin you need to know about late Bobby Brown Jr.

ncG1vNJzZmivp6x7o67CZ5qopV%2BltqWzyKdmraeinnp2gJhybnJrYg%3D%3D